PRESIDO DON CARRY MINISTERS HANDICAP - RESIGN IF YOU WAN CONTEST!

 

 

BY EBUZMAN

 

Presido muhammadu Buhari don tell all him ministers wey wan run for political office for 2023 say make dem by demself write their resignation letter, Submit for him office on or before Monday 16th of may 2022.

Na the minister of informate and culture Alhaji Lai Mohammed yarn this one after the federal executive council meeting wey dem do for abuja today.

Those wey this matter go touch na the minister for justice and Attorney General of we federation Abubakar Malami, Transportation minister Rotimi Amaechi, Minister of Niger Delta, Godswill Akpabio, Labour and Employment, Dr Chris Ngige,Minister of Science and technology, Ogbonnaya Onu, and Minister of state of Education, Emeka Nwajiuba. Na all these ones don buy form to run for presido office for the Apc.

Others wey dey na the minister of state mines and steel Uche ogar wey don buy governorship form for Abia state, Also the minister for women affairs madam Pauline Tallen wey don also buy form form for senate for plateau state.

Oga lai mohammed kon add say this matter no consine we vice presido Yemi Osinbajo because him position na election carry am enter there.

 

 Sometimes na Iron hand some people need😂😂✌



 

 

 

Comments

Popular Posts