SUPER EAGLES DON GET FINE MAN AS COACH!


The Nigeria football federation don today announce Fineboy Jose Peseiro as the new coach of the super Eagles. The Appointment na Sharp one as na chikini sumtin remain make dem agree every every with Peseiro.

Incase you no know who the new coach be, Him full name wey papa and mama give am na Jóse Vitor Dos Santos Peseiro, Him be 62yrs Old and portugal him come from.

When him dey play ball those years na Striker him be. Even now as coach, him don get beta experience with both Clubs and National teams. Him don coach for different Continents like Europe, Asia, Africa and South America. Him don coach some clubs like Sporting Lisbon, fc porto, Panathanaikos, Rapid Bucharest, Sporting Braga, Victoria Gumaraes, Al-Hilal, Al-Wahda, Al-Ahly cairo, Sharjah fc and Assistant coach of Realmadrid during the Era of the galacticos, and also him na former coach of the Saudi Arabia and venezuela national team.

So like this now, na Peseiro go dey in charge of the 2 friendly matches wey we super eagles go play against Ecuador and mexico for America on may 28 and june 2nd 2022.

The NFF don also announce say na Finidi George go be the first assistant coach, whereas Salisu yusuf go be 2nd assistant coach now and also him go be coach of the home based eagles aka chan eagles and we under 23team. Usman Abdallah go be 3rd Assistant, Eboboritse Uwejamomere go be the match analyst and before goalkeeper Ike shorounmu go be the Goalkeeper trainer. 

We dey wish the super Eagles the best of luck, But no forget say we still no qualify for the Fifa world cup Qatar 2022.🤧

Comments

Popular Posts