REAL MADRID DON BECOME CHAMPIONS OF THE LALIGA


By Ebuzman




Real madrid don win their LaLiga title number 35 after Rodrygo score two goals for the first half as dem nak Espanyol 4 kondo on Saturday.

This winning come make Carlo Ancelotti the only coach for the full world to win League title for inside the top leagues for the world, from England, france, Italy, Germany and now Spain.

Ancelotti rest many of him players for the match because their eye still dey the return leg of their match against manchester city for the uefa champions league.

Real madrid win the league with 81points with four games wey remain wey dem no need play at all if dem like. Bcos even people wey dey second wey be sevilla, Madrid dey use 17points gap dem. 

Congratulations to REAL MADRID! CHAMPIONS OF SPAIN!!

Comments

Popular Posts