FIRST LADY WAN DO LOVE FEAST FOR ABUJA



 BY EBUZMAN



Wife of we presido Dr Mrs Aisha Buhari don carry invitation letter carry give all the people wey wan contest for presido office for we country. She invite all of dem make dem follow her come break fasting on Saturday evening for Abuja.

According to the informate wey dey for inside the letter, the groove go happen for inside the state house conference centre by 6:30pm on Saturday evening, April 23 2022.

 

But the comma wey dey there na say, she write for the invitation letter say make dem no bother carry their phone come for where the event wan shele. All dem need na just to come with the invitation card so the security people go allow dem enter.

 

The only set of people wey this one no consince na we vice presido and other ministers wey she invite to come join her for the flexing.. Na the Invitation card you dey see for down so

 

 

 


The person wey confamento this tory, na the talk-talk person to we first lady Aliyu Abdullahi.

 

Hmmmm…… How una take see this matter? Abeg make I hear from una for the comment section. And no forget to write am for we beta style wey be pidgin.


Comments

Popular Posts