YUL EDOCHIE SAY MAKE UNA CONTRIBUTE MONEY FOR PRESIDO FOR AM

 


Actor Yul Edochie just dey use everybody catch cruise ontop this matter wey consine him marriage.

Na our own we dey this week wey him come out yarn say him don get second wife, even don born pikin join. 2seconds everywhere burst with him matter for every social media platform. But as the matter dey be now, e be like say na cashout this bros dey use the matter cash out ooo! Bcos now him don increase the amount wey him dey charge for advert for him page.

Now him don dey ask naija people say with the coperation wey una take make him matter trend, make una use that same energy contribute money go buy form for am to contest for presido of naija. LOL..... Una dey see the guy.



Comments

Popular Posts