TWO BARAWO FOR SOUTHAFRICA FOWL DON LAY COOK EGG



BY EBUZMAN



Two barawo for south Africa fowl don lay cook egg o!!! According to how we take hear the tory, the two robbers being burst in enter the grandma house for Pretoria-south Africa to move things for night as she dey sleep and only she dey stay.

But dem no know say the house wey dem enter no be ordinary house wey anyhow person dey enter. As dem burst in like vandamme. dem carry her plasma tv, microwave, shoes, and plenty other things. Where the ghenghen come happen na As them carry the things waka reach her door to comot, na so Africa magic Yoruba hold dem for door, na so dem drop the things for ground begin sleep beta sleep until the grandma and neighbours wake up come meet them there for ground as dem dey enjoy sleep with the properties wey dem move all of them tanda there.

When we kon chook eye put for the matter, we kon hear say e get one “JUJU” for southy wey dem dey call “umthi” and na im many southy people take dem guide dem selves from bad guys, dem even yarn say if door dey open too dem no born anybody well to enter inside take anything comot from there.

 

SEE LEVELS NAAA!

WAHALA!!!!!

 

Comments

Popular Posts