FOOTBALL AGENT MINO RAIOLA DON KICK BUCKET.



Ogbonge football agent Mino Raiola don kick Bucket for the age of 54 from sickness wey be say nobody don know wetin e be.

The news of him death being break yesterday. But tweet from him verified Twitter handle cancel the rumor.

The family don come out by demself to tell everybody especially football fans say the super Agent don go join him ancestors.

Mino Raiola na Big time football agent for obodo D world wey manage ogbonge players like Pogba, Halland, Ibrahimovic and plenty others before him kpai.

According to obodoyibo newspaper Daily Mail, dem being carry Oga Raiola go hospital for milan for January to do surgery when him being sick before. But the main koko of the sickness nobody don know wetin e be. 

This na the message from the family.🤧🤧🥺



Comments

Popular Posts