FLYING EAGLES COACH DON READY HIM SQUAD

Flying Eagles head coach Ladan Bosso don select 28players wey go play against Ghana and Burkina faso for the group B of the wafu B zone qualifiers wey go begin shele for inside Niamey for Niger Republic.

For the Group A na there the host Niger Republic dey together with Togo, Cote d ivore, and Benin republic.

The flying Eagles go first battle against Ghana for Sunday wey be may 8, then 3 days after dem go enter one trouser against Burkinafaso. The two matches na for the General Seyni Kountche stadium for Niamey all go happen.

Na two countries go qualify from the two groups enter straight to semi final. Then the two team wey enter final go represent the WAFU B Zone for the 2023 Africa u-20 cup of Nations.

Comments

Popular Posts