TWITTER OGA DON SELL HIM BIRTHRIGHT BCOS OF MONEY.





 BY EBUZMAN


The person wey join hand start the social media website wey people dey always talk their mind wey we know as twitter wey him name na JACK DORSEY, don come outside yarn say as the richest man in the world ELON MUSK don carry money buy him company wey be twitter, say the thing sweet him body no be small. Infact, him describe Oga musk as the only solution wey him trust to anything wey consine twitter.

As the gist take come, Na here we dey ooo wey we hear say oga musk don carry beta money wey reach $44billion take sama give twitter people dem, wey dem agree to sell the company give oga musk.

Na so oga DORSEY come for twitter talk say make people no fear as no shaking at all at all, because as things take be right now, na
Oga Elon musk be the only solution wey him fit use him life take bet ontop. sake of say wetin dey him mind to do ontop twitter matter na the same thing dey oga Elon musk mind to do and even more sef,

Dis na wetin Oga Jack Dorsey write



Him yarn say him love twitter dye, and na one of the things wey dey connect people together. Him add say, the idea and wetin oga musk yarn say him go do, na that one sweet him belle.

From the thing wey him yarn, him say when him start twitter, him no think am for one day say e go be one man property. But when Elon musk carry him plans come, and him check am, na wetin make am believe say na Elon musk be
the only person wey fit run twitter package by himself. ( I feel say na the money wey him see sha).

Abi wetin una feel?






Comments

Popular Posts