NIGERIAN RAILWAY CORPORATION SAY MAKE UNA READY TO USE NIN TO ENTER TRAIN.

 Chukw (EBUZMAN)

PESIN WEY WRITE AM NA

Ezeobika Chukwuebuka (EBUZMAN)



The naija railway corporation don yarn say from the month of may 2022, Naija people go need to submit their national identification number aka NIN as part of requirement to take enter train take do their movements.

Na the Managing director of the NRC, Mr Fidet Okhiria yarn this one on Thursday April 14, as him yarn say this one go add to the number of security measures wey dem wan put in place for train transportation for we country.

Him yarn say, the Abuja – Kaduna train service go resume very soon with ogbonge security wey dem don add join the ones wey dey before, Him no forget to do sorry give the families wey their person being kpai from that badness wey happen for there.

Him kon add say incase anybody person still dey loss, make dem call this number for beta helep 08033546208, 08060044600 and 07066700150.

All this one dey happen weeks after some jaguda terrorists being attack the train, kpai 8 people inside kon koloby many of them Enter bush.

 

Comments

Popular Posts