Terrorist wey kidnap people for train, don release picture of the baby wey the pregnant woman born.




One woman wey get belle from among the women wey bad guys being kidnap from the Abuja - Kaduna train don born her baby for the kidnappers den.

According to the tori wey we hear, the woman being dey 8months pregnant before dem be kidnap dem for the 28 2022.

The tori of say she don born being trend for social media this week but nobody know if na boy or girl she born until on Wednesday wey one of the kidnappers being post picture of the baby for all to see say na Girl the baby be.

According to one of the woman relation wey do Interview with tori people, but say make we hide her name, she say the bad guys don already call them to inform dem say she don born the pikin for their side.


Comments

Popular Posts