Love in the air as Davido don celebrate Chioma on her birthday 🥂🎂


Popular naija singer David Adeleke aka Davido don celebrate him baby mama chioma for social media based on today na her birthday.

Today na mama ifeanyi 27yrs birthday and na she born Davido 3rd pikin Ifeanyi Adeleke.

Davido post the picture for him instagram story as him just dey pray for her as she don be +1 today.

Davido write say "Happy birthday ChiomChiom, i pray make God continue to bless you, and continue to dey give you everything wey you deserve and add jara ontop". Chi day🍷🥂!!! Turn up to the fullest!
You deserve am❤️

Chioma being come out for instagram announce say today na her birthday with better picture wey dey enter eyezz. As e be say she don grow and she don fine more more.





Comments

Popular Posts